Nigeria ruling and opposition parties don postpone governorship primaries for some states

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria main opposition Peoples Democratic Party (PDP) don postpone dia primary election for Lagos, Kano and Imo states but dem neva announce new date.
Di National Publicity Secretary for PDP, Kola Ologbodiyan tell BBC Pidgin say concerns witin di party to allow more tok-tok na im make dem post pone di primaries for does 3 state.
Oga Ologbodiyan say e no fit tok di exact date now wey dem go do di primaries for di three states but e fit be 'either Monday or any oda day."
"We get grace period from between now and 6 October so wen we agree for di day to do am, we go announce am."
For one statement, PDP say dia primary for oda state go still happun today as dem plan am before.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Meanwhile, di ruling All Progressives Congress (APC) don shift Lagos and Imo state governorship primary elections wey suppose happun today go tomorrow 1 October.
Adams Oshiomhole, di national chairman announce dis give tori pipo, say di remaining 27 states go happun today as dem plan am.
Di party say na logistics problems make dem postpone election for di two states.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oshiomhole say e reach like over 77 pipo wey dey hustle for di party governorship tickets all over di kontri and dem get only 29 vacancies for governors.











