You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Mama Taraba, oga Buhari Former Minister for Women Affairs don use vex resign APC, join tear rubber party
Former Nigeria Women Affairs Minister, Aisha Jummai Alhassan don join tear rubber political party di United Democratic Party (UDP) afta she use vex comot di ruling All Progressives Congress (APC).
She cari yan go Twitter say, she plus seven state assembly members, local and state goment executives plus odas don pack dia load go UDP.
Alhassan resign as goment minister and member of APC for early morn morn today wit letter she write to her oga President Muhammadu Buhari.
Why Mama Taraba resign
Presido Buhari bin appoint Madam Alhassan, wey pipo dey call Mama Taraba, for 2015.
For di letter wey she write go give Presido Buhari on September 29, Mama Taraba complain say APC national working committee no give her any beta reason why dem disqualify her not to contest for 2019 govnorship election inside Taraba State.
Madam Alhassan claim say dis na big injustice against her afta she don buy di form finish and don be loyal member of di party since 2014.
She say sake of dis ojoro wey dem do her, she decide to resign as e be say since dem say she nor qualify to contest, then she no still qualify to remain as APC member and as minister.
Dis resign dey come afta APC screen her comot not to join those wey wan contest dia party govnorship primaries wey dem wan do September 30.
End of Di one wey oda users dey read well well
E get one time wey pipo surprise for Mama Taraba as she tok for public say she dey loyal to former Vice President Atiku Abubakar.