You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kemi Adeosun don resign as Nigeria Finance Minister
Nigeria goment confam Friday night say di Finance Minister Kemi Adeosun don resign afta almost three years for office.
Madam Adeosun resign becos she find out say di National Youth Service Corps (NYSC) certificate wey she use qualify to become minister na fake, according to reason she give for her resign letter.
She feel say her position for office go cause wahala for President Buhari campaign for im 2019 elections, according to Nigeria local media.
Zainab Ahmed na di Acting Minister of Finance wey Presido Muhammadu Buhari appoint as e accept make Kemi waka.
Tori of Kemi Adeosun resign first break Friday afternoon for Nigeria local media witout official confamation on top di mata.
Tori be say for July 2018, tori pipo Premium Times bin do investigate wey show say di minister forge her National Youth Service Corps (NYSC) certificate.
Na Friday for inside di resign letter Adeosun tok anytin for di first time about di accuse wey make her resign.