US First Lady Melania Trump go visit Ghana, Kenya den other African countries

Wia dis foto come from, Reuters
US First Lady, Melania Trump say she go visit Ghana, Malawi, Kenya den Egypt coming October for en solo international mission.
She explain say dem select these countries sake of dem dey work plus USAID den partners to overcome some of dema biggest challenges in healthcare den tins.
She talk dis on Wednesday for di reception wey dem organise give spouses of foreign leaders den others wey dey participate for di annual U.N. General Assembly.
"For Ghana, USAID's programs dey focus on healthcare, dem dey expand di coverage den quality of healthcare give mothers den dema newborns, wey dem dey educate women den young children about di importance of proper nutrition," Melania Trump talk.
Mrs Trump reveal say during en visit, she go promote "Be Best" child welfare initiative throughout Africa which dem launch dis year to focus on dema overall child well-being.
She however no give details of en activities for each country wey she no talk when she dey return go Washington.







