Trump in-law don get American citizenship

Wia dis foto come from, AFP/GETTY
President Donald Trump parents-in-law don become American citizens.
Viktor and Amalija Knavs, wey be di papa and mama of oga Trump wife, Melania Trump take di oath of citizenship for New York on Thursday for one private ceremony, according to dia lawyer Michael Wildes.
Mr Wildes wey attend di ceremony wit dem, say di parents wey come from Slovenian don dey live for US on green cards wey dia daughter, Mrs Trump sponsor.
President Trump don bin dey kick against family-based or "chain" immigration before.
E argument be say make di immigration law dey consider professionals first more than relatives, and dis im attack against di immigration laws and immigrants don make plenty pipo dey criticise am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Melania Trump become US citizen for 2006, afta she enta America through Einstein visa for pipo wey get "extraordinary ability" for 2001 wen she dey work as model.
Under US immigration law, Melania papa and mama need to don first green cards for at least five years before dem go fit apply for citizenship.

Wia dis foto come from, Getty Images
According to di US Citizenship and Immigration Services website, average naturalisation application for New York dey take between 11 and 21 months and dis one depend on di plenti character and residency requirements.
End of Di one wey oda users dey read well well
New York Times report say lawyer to Melania Trump parents, Mr Wildes tell tori pipo say dem don met di five year condition but e no gree give more informate about am.
Mr Wildes describe family-based migration say na " bedrock of our immigration process", and wen tori pipo as am if Melania Trump parents get dia citizenship through di system, he reply say "I suppose".











