Osun rerun election: ''We no go gree for di result sake of say na wayo election'' -PDP

Osun election
Read am in 3 mins

Hon. Soji Adagunodo, wey be Osun state oga for di People's Democratic Party (PDP), don tok say di Osun re-run govnorship election na attack on democracy and di biggest tiff-tiff wey don happun for di south west state for Nigeria.

Oga Adagunodo cari blame put for di head of dia rival di All Progressive Party (APC) for di 'election wayo' afta im claim say APC thugs no gree make pipo for Orolu, Ife North and Ife South local goments vote.

Among di accuse im tok include;

  • Plenti of dia supporters for Orolu, Ife North and Ife South local goments suffer attack wey include gunshots and cutlass for di front of security operatives wey cari eye comot.
  • Hundreds of pipo wey cari PVC for oda polling centres get chance to vote for Osogbo and Ife South local goments.
  • Dem block tori pipo and election observers to enta some polling centres.
  • By di time tori pipo see chance to enta di polling centres around 11am, APC agents wey dey work wit INEC officials don full ballot boxes wit APC votes.
  • Dem use axe to attack one PDP agent for Olode.
Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Adagunodo tok say e dey pain am as di election wey INEC organise for di seven polling centres no dey free and fair.

Na sake of dis im say im no go agree any result from dis 'wayo election' and im advice INEC authorities for Abuja to stop to dey count di votes.

Voting don finish for some polling centres and INEC officials don already begin count votes.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Voting no dey smooth like last weekend own

Di rerun govnorship election no gentle like last weekend own.

BBC tori pesin wey dey ground don tok say some voters and election observers suffer harsh treatment for di hand of security agents and rival party officials wey dey block road to polling centres.

PDP and APC contest inside four local goment areas wey INEC bin cancel last weekend.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Skip X post, 4

End of X post, 4

PDP lead di first round

On Saturday, dem bin do di govnorship election but INEC say e dey inconclusive as some regions no see space to vote.

As of Sunday September 23, PDP bin dey lead di ballot with 254,698 votes, while APC bin no slack back with 254,345 votes, SDP get 128,049 votes, ADP get 49,744 and ADC get 7,681 votes.

Becos of di number of cancelled votes pass we, na im make INEC declare am as inconclusive.

IDT
Wetin we call dis foto, INEC say na only those places wey dem announce say dem cancel vote, di election go happun

INEC bin release say, pipo wey register to fit vote on Thursday na 3,498 dem be for seven polling units inside 4 local goment areas.

Some tori toke say police dey prevent news pipo to cover di election, wey make INEC to tweet say:

Skip X post, 5
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 5