You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Osun state election: INEC don tok di political party dem wey go do rerun on Thursday
Di Independent Electoral Commission (INEC) for Nigeria say na all di political parties wey bin contest di govnorship election on Saturday 22 September go contest for di rerun on Thursday 27 September.
Dat one mean say no be just di People's Democratic Party (PDP) candidate Senator Ademola Adeleke or dat of di All Progressives Congress (APC) Gboyega Oyetola wey bin finish as number one and two go contest di election. E pass 40 candidates wey contest to be govnor of di state.
Oluwole Osaze Uzizi, wey be director voter education and publicity for INEC, tell BBC Pidgin say di rerun election go happun for polling units wey tins bin no go well on Saturday.
"No be only APC and PDP go contest di election as many pipo dey tink," im tok.
Osun State for south west Nigeria go do rerun of dia govnorship election on Thursday 24 September. Dem bin first do di election for Saturday 22 September, but dem no fit find winner as di Independent National Electoral Commission say di election dey inconclusive.
INEC give reason why dem tok dat on ontop dia twitter handle:
Na for di whole of Osun State di election go happun?
Di ansa na no. No be everi bodi wey bin vote on Saturday 22 September go vote for di rerun. INEC say na only those places wey dem announce say dem cancel vote, di election go happun for. By wetin INEC release, pipo wey register to fit vote on Thursday na 3,498 dem be for seven polling units inside 4 local goment areas. E no mean say all of dem must come out to vote on dat day, dis na only number of pipo wey dey registered.
Wetin go happun next?
Wen dem do di election finish on Thursday, dem go add di new result to wetin each candidate bin get before.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wen dem add evri evri, di pesin wey im result big pass na im dem go declare winner of di election.
As e be so, na either di PDP candidate Senator Ademola Adeleke or dat of di APC Gboyega Oyetola fit win di election because of di number of votes wey dem don already get.