Abuja earth tremor: Borehole wey pipo dey drill upandan na im make ground shake

Wia dis foto come from, Getty Images
Pipo wey dey sink borehole anyhow for Nigeria capital Abuja, follow for wetin make ground shake for some parts of di city earlier dis month. Na one report wey torchlight wetin happun tok dis one.
Di presidential committee wey dem set up to torchlight wetin cause di shaking wey pipo wey dey live for di city bin feel between September 5 and 7, say no be quarry activities bin cause am as pipo bin tink.
Director-General of di National Space Research and Development Agency (NASRDA), Seidu Mohammed wey head di committee, give goment di report on Friday. Dem say according to wetin dem discover, some spots and locations don dey identified as place wey earthquake fit happun for Nigeria, particularly for Abuja.
Di committee say pipo wey dey sink borehole anyhow for di city na big problem. Dem recommended say make goment use strong hand check those kain activities for Abuja.
Dem say di one wey make ground shake recently na because of di many drilling of boreholes and 330,000 metric tonnes of water dem dey comot from ground everiday.
Dem say ground go continue to dey shake if goment no find lasting solution to how pipo take dey drill borehole for di kontri.
Di committee wey cari dia report give Minister of Science and Technology Dr Ogbonnaya Onu for Abuja, say possibility dey high say ground go shake again for Nigeria and say oda places e fit happun na Bayelsa, Oyo and Kaduna states.









