'Di Kenyan wey kill Nigeria Air' plus oda RIP reactions

Read am in 2 mins

Nigerians don start to share wetin dem tink afta goment announce say dem go match brake for Nigeria Air until further notice.

Minister of State for Aviation Senator Hadi Sirika na im make dis announcement afta federal executive council meeting. Dis dey come three months before di airline suppose launch officially for December.

E neva too tey wey pesin for Kenya bin dey yab Nigeria Airlines come receive di full load of Naija Twitter. But e be like e bin don see wetin dey come.

Some pipo dey wey tok say dem bin know say e no go work from day one.

While odas dey tok "rest in peace" for di airline as per e don die.

And odas want make di Economic and Financial Crimes commission investigate di mata.

While oda pipo dey use di mata dey joke.