You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria Air: Goment don match break before airline even begin fly
Read am in 1 mins
Federal goment don suspend everitin wey concern di National Carrier, Nigeria Air.
Minister of State for Aviation, Senator Hadi Sirika announce dis one for Abuja on Wednesday wen im tok wit tori pipo.
Oga Sirika wey no give any reason why dem dey suspend am, say di federal goment take di decision for di federal executive council meeting.