You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria Air: Rich man fit meet poor man - Aviation Minister Hadi Sirika
On Wednesday 18 July for London, United Kingdom, Nigeria Minister of State for Aviation, Hadi Sirika announce say new national airline don land and go start work for December.
Nigeria Air, wey be di name of di new airline, dey show 15 years afta im grandpapa, Nigeria Airways stop to dey work.
Nigerians don dey debate upandan on top di mata as some pipo hail di mata as correct tin and odas dey yab goment say na airline dem go chop?
BBC tori pesin Peter Okwoche follow oga Sirika sidon to discuss di mata.