You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria Air: How pipo dey react on top di new airline
Nigeria goment don announce say new national airline don land and go start work for December.
Nigeria Air, wey be di name of di new airline, dey show 15 years afta di old one, Nigeria Airways stop to dey work.
Di kontri bin try to start anoda one since - Air Nigeria (aka Virgin Nigeria), den Nigerian Eagle Airlines - but e no work.
Afta Aviation minister, Hadi Sirika, announce am for di Farnborough Airshow for United Kingdom, na so Nigeria Twitter catch fire.
Some pipo jolli say di airline don land
Some dey scratch head say which kain logo be dis?
Di tin wey concern some pipo na weda di airline go go di way of im grandpapa Nigeria Airways
Em...but oda serious mata start to dey show...
End of Di one wey oda users dey read well well
...load...
...small or big chops...
...some pipo sef don alreadi dey advertise diasef for work
On top dis work mata, Chairman of Nigeria Airways' branch of di Nigeria Union of Pensioners (NUP), Sam Ezene bin tell BBC Pidgin say im and e members get shock wen tori land say goment don announce new national airline, say goment no suppose launch Nigeria Air unto say dem owe dem pensions reach 14 years.
''Dem suppose take care of di final entitlement of di workers of di former national carrier first,'' im tok.
Im accuse goment say dem do u-turn, go England go launch new airline, and say e no sweet for belle and e no good for di image of di kontri.
But upon all dis, e be like say Nigerians don embrace di new airline and don ready to climb enta di first flight.