$60 million don grow wings, fly like bird then vanish like ghost for Liberia

George Weah

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Liberia President George Weah

Liberia goment say e dey investigate how two bullion vans wey dey cari tear rubber money of up to $60m vanish for di capital, Monrovia.

Tori be say security escort dey cari di mint money, wey dem ship cari come from obodo oyinbo, from port go Liberia Central Bank wen e vanish like ghost for March dis year.

Di justice ministry don tell Liberia pipo say make dem no fear as security officials dey investigate di mata.

Minister of Information Eugene Nagbe tok say President George Weah no hapi sake of say no one tell am wetin dey until now.

Nabge say, ''Dis na serious somtin".

As tins dey dem never arrest anybodi on top di mata but di information minister say im dey sure e no go tey before di mata clear like sun for dia eye.

Liberia don nack travel ban for di head of some big pipo for di kontri wey include Charles Sirleaf di former govnor of Liberia Central Bank and pikin of former presido Ellen Johnson-Sirleaf.