Liberians dey sing "bring back our moni" afta $100m grow wings vanish like ghost

Wia dis foto come from, iStock
Di song "Bring back our moni" by MC Caro na one of di ways kontri pipo for Liberia dey use call attention to di two shipping containers with around 100 million dollars inside wey disappear.
Di moni wey dem print for Sweden bin land port for di kontri but before dem go cari am reach di Central Bank, di two containers just vanish and nobody know wia e dey.
On Monday 24 September, kontri pipo vex enta street for di capital city, Monrovia to protest.
Goment don launch investigate to torch light di mata. Dem don also ban 15 officials make dem no comot di kontri. Charles Sirleaf wey be di former central bank govnor and pikin of former President Ellen Johnson Sirleaf na one of di officials wey no fit comot di kontri as e be so.
Liberians dey para no be small from dis latest kwanta even as inflation still rise, dey suffer kontri pipo. Since George Weah enta office, di Liberian dollar don fall 20% against di US dollar.
Dis palava fit reduce di Weah supporters wey bin get high hope for im goment.







