An Nisa: Taxi wey go cari only women and pikin don launch for Kenya

Wia dis foto come from, Facebook/An Nisa Taxi
Safety for women wey dey enta taxi na one of di 21st wahala for some kontris, but one company tink say dem get solution. Use female drivers wey cari only female passengers.
An Nisa na taxi hailing app wey dey run for Kenya and get only women drivers and e dey pick only women and children for dia ride.
Di founder, Mehnaz Sarwar tok say di reason she start am na because she dey uncomfortable wen male drivers dey drive am and she notice say many women dey di same situation as her.
One driver tok say e dey different from di kain taxi app di oda ones wey she don drive with before dey use because as soon as women book am and see say na for women only, dem dey support am pass sef.
For world now, na only three percent of di drivers for driving apps be women even as di number of women wey dey book am dey more by far.







