Five cities wey no safe for women

Wia dis foto come from, Getty Images
Plenty places dey for world wey dey hard for women to live. Dis na according to di Thomas Reuter Foundation.
Dem do research for 19 big cities for all over di world wey if you be woman, things go hard for you pass as e hard for man.
Di issues wey dem use judge di matter for their research na:
- Sexual violence
- Woman health
- Culture and traditions
- Money matter.
Make we see some of di cities wey dey di list.
Lagos, Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images
Lagos enter di list as number eight worst place for women to stay for world. Di reason na say dem get ancient traditions wey women dey suffer wey include circumcision for women.
Another issue na money matter, di research see say women no dey too get help for di city to start business like that.
Lima, Peru

Wia dis foto come from, Getty Images
Lima, wey dey Peru for South America, be number five for di list of worst cities for woman to live.
E get di worst rating for woman health care on top say dem no get better healthcare for women wey wan born and di number of women wey dey die sake of say dem wan born too high.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem also get wahala for women security for di place and money matter for women no too good for di area.
Delhi, India

Wia dis foto come from, Getty Images
New Delhi na India capital wey people plenty well-well. Rape for dia bad sotay people dey call di place di "rape capital" of India.
Di way wey dem dey treat women as e concern money matter, education and to buy land or house dey too bad.
Kinshasa, Democratic Republic of Congo

Wia dis foto come from, Getty Images
Kinshasa for Congo carry medal for di second worst city for woman. Di way wey dem dey treat women for money matter and education na di worst for di big cities for di world.
Dem no come get better health care to help women. Dem get di second worst healthcare for women.
Cairo, Egypt

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis city carry position as di worst city for women to live inside. Dem tradition dey force women to do circumcision and by-force marriage.
No be only dat one, as dem no fit even protect their women from sexual violence.












