Female artists dey use art exhibition to celebrate oda women

Wetin we call dis Video, Society no suppose judge women sake of how dem look
    • Author, Karina Igonikon
    • Role, Reporter, BBC News Pidgin

Female artists for Nigeria dey always do art exhibition for di past six years to celebrate International Women's Day.

Dis year, dem dey add dia voice to stop violence against women and to say make dem carry women too for politics or business so dat women too fit fulfil dia potentials.

Ngozi Akande, wey be di President of di association say every art work dem exhibit na to encourage women say make anything no discourage dem, but make dem follow dia dream as dem fit do anything, like her paint work, 'Looking into di future' dey show.

Art work 'Looking into di future' wey Ngozi Akande do
Wetin we call dis foto, Di future dey bright for women to achieve dia dreams

Di US Consul General, John Bray and Director General National Council for Arts and Culture Segun Runsewe, mama of art for Nigeria, Nike Davies Okundaye follow come di exhibition to support women.

Mr Gray say everyday na women's day as only one day no reach to celebrate di good things women dey do.

Art work dem wey Eghosa Henry Osaretin do wey show for di art Female Artists Association exhibition for 2018 IWD
Wetin we call dis foto, Society no suppose judge women sake of how dem look. Plenty beta things dey inside dem

Omoniyi Dotun Victor wey wey show to rep Council of Arts say dem like as di female artists dem come out to celebrate as women na pillar of society and dem ready to give dem every support to ginger dem to move forward as di theme of di celebrations talk.

'I love my body' 3 piece series wey Abisola Gbadamosi do for di FAAN art exhibition
Wetin we call dis foto, Women no suppose dey shame sake of dia bodi as dem get mind, spirit and soul.
'Girl not Bride' art work wey Clara Aden do
Wetin we call dis foto, Di art work dem dey add mouth to stop violence against women and child marriage
Female Artists Association of Nigeria with di US Consul General to Nigeria, John Bray for 2018 International women's day art exhibition
Wetin we call dis foto, When women come togeda, dem fit do anything as na dem be pillar of society