Di artist wey dey dance naked

Wetin we call dis Video, Di artist wey dey dance naked
    • Author, Karina Igonikon
    • Role, Reporter, BBC News Pidgin

Wen for 2015 Emmanuel Luka Musa tell im directors and producers say im wan perform naked, dem think say im don mad.

"Art na mirror of reality," im talk.

Im say im work: "Evolution" na to tell di tori of man, wia we from, wia we dey and wia we dey go. So im decide to go on stage stark naked from di beginning because "wen dem born us, we no wear cloth."

Right now di dancer dey do tour but e don do oda drama and musicals too like "Jesus Christ superstar", "Kakadu di Musical", "Saro di Musical" and "Circle of Music".

Emmanuel Luka Musa wen e do 'Dance with di waves'

Wia dis foto come from, Emmanuel Luka Musa/Youtube

Wetin we call dis foto, Musa belive say dancers na artists wey dey show wetin dey happen for society

Musa say im wonda how pipo go think to see person naked for stage and e say im mind cut di first time e perform am for Kari Tanzhaus festival Kempten for Germany for 2015.

Critics dem plenty, but e surprise as dem like am well well and from dia e begin get booking.

Dancers wey dey dance di piece 'Udide' for Kempten Germany

Wia dis foto come from, Emmanuel Luka Musa/Youtube

Wetin we call dis foto, Musa say some audience for Nigeria neva mature for naked performance and e no go like to dey perform and pipo dey complain, but im fit perform naked for di right audience

Musa dey encourage parents to support dia pickin dem wey wan do art, say art no be for wayward pipo as dem dey think but artist dey show society as e be. Im say di support im papa give am really help am as im papa say im dey brave to perform naked and dat one give am mind to continue.

Im say for im to perform naked na to tell tori, no be to encourage pipo to waka naked for road. Im see great things for dance for Nigeria as e dey possible say dancer fit sidon for Aso rock and e go do well as dem know how e be as mirror of society and fit do wetin go solve di palava dem.