Mamoudou Gassamma: Mali Spiderman don become French Spiderman

Mamoudou Gassama

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Mamoudou Gassama life change afta im climb storey building to rescue pikin wey hang for balcony for Paris

Between Mali and France, which one you go choose? Well, Mamoudou Gassamma pick France Thursday as e become full fledged French citizen September 13.

Gassama bin get di name wey be "Mali Spiderman" afta e use only im hand to climb four floors to save four year old pikin wey bin dey hang for balcony.

Gassama bin collect im special accolades last week of May from French presido Macron wey bin offer am work with di Paris Fire Service.

Di official decree wey dem bin use make am citizen also give am accolades for wetin dem call im "great bravery".

Gassama bin first collect French residency wey be di first step to citizenship and den speed im citizenship for France.

E bin enta France for 2017 as irregular migrant and e bin dey work for one construction for Paris.

As e don get citizenship for France e go fit live and work for di kontri and dem overseas territory.