Abuja village wey women vow to shun voting for 2019

Some women for one village for Abuja, Nigeria capital, don tire for empty politician promise sotay dem don decide say nobodi go see dia leg near any polling station for 2019 election.
45-year-old Aishatu dey live for Kaida Sabo village for Gwagwala, and she get eye problem.
She say each time she wan see doctor, na to waka several kilometres to anoda community because her village no get primary health care centre.

Halilu Ayali say every election year, politicians go line up for dia village dey do campaign, dey promise good road and evri-evri.
But dat afta di election, dem no keep to dia promises.
And dat because of dat, dem no get reasons to vote for 2019 election.
Madam Rhoda, wey dey live for di community, say women na dem di suffer pass for lack of social amenities for di area

Most pregnant women dey follow do dis kain journey and many of dem tell BBC Pidgin say di upandan waka don make dem lose dia pikin during child birth.
End of Di one wey oda users dey read well well
Aishatu tok say "Na almost four years na im dem start dis hospital building and dem neva complete am."

Di women for di community say e dey cost dem time, money and life to go hospital for oda communities and dat dem surprise dat even though goment bin promise health care for rural communities, dia community neva benefit.

Primary health care no be di only problem for di community.
Dem no get light, secondary school and good roads.
Most times afta dem harvest dia farm products, to cari go market na helele and water no dey dey for dry season.











