Technovation 2018: Meet di Nigerian girls wey win Silicon Valley competition wit fight fake medicine app

Wia dis foto come from, @technovation
One team of young girls wey represent Nigeria, dust America, Spain, Turkey, Uzbekistan and China to win di junior division of di 2018 Technovation world pitch for San Francisco, US.
Di Nigeria team wey call demsef Save-A-Soul, bin develop mobile app wey dem call 'FD Detector.' Di work of di app na to helep fight di wahala of fake drugs for dia kontri.
Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of YouTube post
Dem select di girls out of 2000 app developers wey bin show to represent Africa for di world pitch.
Dis na di first time junior Nigeria team dey reach finals to visit Silicone Valley. Di girls go try sell dia app to investors wey dey Silicon Valley, California.
Even acting presido of Nigeria, Prof. Yemi Osinbajo enta twitter to clap for dem:
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Technovation na special programme wey dey encourage girls to discover problem wey dey dia community, den develop app to solve am.

Wia dis foto come from, edufuntechniknig
According to team Save-A-Soul, Nigeria get di largest market for fake drugs.
Di girls wey come from Anambra State, south-east Nigeria say dia plan na to do collabo wit National Agency for Food Drug Administration and Control (NAFDAC) so dat dem go use di app solve dis wahala.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na on Thursday night dem get di award, afta dem face judges from different parts of di world.











