Silicon Valley dey host Nigeria VP Osinbajo and oda young Nigerians

Osinbajo and Tuface

Wia dis foto come from, @ProfOsinbajo

Wetin we call dis foto, Osinbajo believe say technology dey create jobs for Nigeria
Read am in 2 mins

Nigeria Vice President Professor Yemi Osinbajo don show for di popular Silicon Valley for California, US to do three days wakabout. Osinbajo wan use di visit bring beta come Nigeria.

Di Vice President travel go di technology headquarters wit some young Nigerians wey be tech entrepreneurs and oga dem for di creative industry. Na just last month Osinbajo launch 50-man Advisory Group on top Technology and Creativity matta for Nigeria and na some of di pipo wey dey di group follow am go Silicon Valley.

Wetin we call dis Video, My app go compete with Instagram - 17 years old

Dis visit no be just to go do wakabout, Osinbajo say im go yan wit di tech ogas for Silicon Valley to come invest for Nigeria technology industry. Di Vice President don already meet with some tech ogas for Google and LinkedIn come still yan wit some creative ogas for Warner Bros, Disney, IMAX and 20th Century Fox.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Osinbajo also meet wit singer Tuface, owner of Ebony Life TV Mo Abudu and visual artist Laolu Senbanjo.

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 4

Dis na small informate about 10 of di young Nigerians wey dey di advisory group.

1. Shola Akinlade

Shola Akinlade.

Wia dis foto come from, Shola Akinlade/twitter

Wetin we call dis foto, Shola na di oga and founder of Paystack wey be online platform to pay and collect money from anybody, anywhere for world. Im read Computer Science for Babcock University, Nigeria.

2. Mark Essien

Mark Essien

Wia dis foto come from, Mark essien/facebook

Wetin we call dis foto, Mark Essien na software developer from Akwa-Ibom State, Nigeria. Im be di founder of hotels.ng, one of di biggest website wey pipo dey use book hotels for Nigeria.

3. Anna Ekeledo

Anna Ekeledo

Wia dis foto come from, Anna Ekeledo/twitter

Wetin we call dis foto, Anna Ekeledo na di Executive Director for Afrilabs wey get technology innovation hubs for different African kontries. She go school for Covenant University, Nigeria and Leeds University Business School, UK.

4. Eloho Omame

Eloho Omame.

Wia dis foto come from, Eloho Omame/facebook

Wetin we call dis foto, Na she be di Managing Director of Endeavor, one multinational company wey dey ginger entrepreneurship for world. Eloho get degree from London Business School. She don work wit First Bank of Nigeria and BudgIT.

5. Bosun Tijani

Bosun Tijani

Wia dis foto come from, Bosun tijani/facebook

Wetin we call dis foto, Bosun na di oga of Co-Creation Hub (CcHub), one of di tech centres wey popular pass for Nigeria sotay Facebook oga Mark Zuckerbeg visit di centre for 2016. Bosun go school for University of Jos, Nigeria and Warwick Business School.