Lagos: Nigerian Insurance Association go pay victim families of di Otedola bridge fire

Wia dis foto come from, @Followlastma
Nigerian Insurance Association (NIA) announce compensation package for those wey lose dia life and thoe wey lose dia vehicle inside Otedola bridge fire.
Dis na even as Lagos State goment dey do meeting with families of victims.
One goment tok tok pesin tell BBC Pidgin say di moni wey NIA go carri go give families go be based on di kain insurance wey dem get - whether na full one or na third party one.
Lagos State goment, Police and NIA go do verification exercise for Ikeja wia dem go check pipo and vehicle record well well so dat money go go to di correct pipo.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Di cause of di fire incident wey happun on on Thursday, 28 June., wey tori be say 9 pipo die inside, na when one fuel tanker wey dey carri 33,000 litres of petrol fall ontop road as e nearly reach Berger, come catch fire.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2







