Katsina Flood: Plenti pipo still dey miss

Katsina flood

Nigeria President Muhammadu Buhari tok say e dey pain am as flood kill plenti pipo for Katsina, wey dey north of di kontri.

Di state Governor, Aminu Masari, confam to tori pipo say e reach 44 pipo wey die for di flood and dem still dey find 20 odas for Jibia, wey di tin happun.

Many pipo no get house again for 10 communities, plus including Tundun Takari, Dan Tudu, Unguwar kwakwa and Unguwar Mai Kwari.

Senior Special Assistant on Media and Publicity, Garba Shehu, tok say di presido don order authorities make dem support pipo wey di flooding affect.

Di rain, wey start Sunday night, fall sotay e no stop until di following day.

Wetin we call dis Video, Rain don come and flood don follow am for Lagos

Jibia chief, Alhaji Rabe Rabi'u, tok say e neva see dat kain rain for im life and e sure say 260 cow die and plenti farms destroy inside.

Wetin we call dis Video, How Lagosians dey use plastics to block waterways

Executive Secretary for Katsina State Emergency Management Agency (SEMA), Dr. Aminu Waziri, say dem don start search-and-rescue to find di pipo wey dey miss.

E say dem dey find temporary house wey dem fit put pipo wey di flood destroy dia house.

Katsina flood
People walk in a flooded area after the Ogun region flooded following a day long torrential rain caused Ogun river to overflow in Lagos, Nigeria on October 7, 2016

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Flooding dey common for Nigeria. E don happun for many states like Benue, Cross River, Ogun and Lagos, wey dis man gada imsef dey waka inside flood water for 2016