Silicon Valley dey host Nigeria VP Osinbajo and oda young Nigerians

Read am in 2 mins

Nigeria Vice President Professor Yemi Osinbajo don show for di popular Silicon Valley for California, US to do three days wakabout. Osinbajo wan use di visit bring beta come Nigeria.

Di Vice President travel go di technology headquarters wit some young Nigerians wey be tech entrepreneurs and oga dem for di creative industry. Na just last month Osinbajo launch 50-man Advisory Group on top Technology and Creativity matta for Nigeria and na some of di pipo wey dey di group follow am go Silicon Valley.

Dis visit no be just to go do wakabout, Osinbajo say im go yan wit di tech ogas for Silicon Valley to come invest for Nigeria technology industry. Di Vice President don already meet with some tech ogas for Google and LinkedIn come still yan wit some creative ogas for Warner Bros, Disney, IMAX and 20th Century Fox.

Osinbajo also meet wit singer Tuface, owner of Ebony Life TV Mo Abudu and visual artist Laolu Senbanjo.

Dis na small informate about 10 of di young Nigerians wey dey di advisory group.

1. Shola Akinlade

2. Mark Essien

3. Anna Ekeledo

4. Eloho Omame

5. Bosun Tijani