You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Internet don craze for man wey dey use blackboard teach computer
Internet cray when dem see foto of Ghana teacher wey dey use blackboard to teach computer.
Kumasi man Richard Appiah Akoto, dey draw correct computer foto give im students as e no get real computer to use teach dem.
Even one computer, di school neva see since 2011. And di students suppose pass information and communications technology (ICT) exam.
Akoto write for Facebook say di mata get as e be.
For im post, Akoto, wey im guy name na Owura Kwadwo, say "I love my students so I dey try do anytin I fit do so dem go understand wetin I dey teach dem."
After di foto show for internet, big computer company, Microsoft, promise say dem go send new computer to Akoto.
Plenty pipo for social media hail am for di way e dey put mind for im work and even businesswoman Rebecca Enonchong tweet give Microsoft Africa say di man dey teach students how to use dia product wey e no even get sef.