Rapper Cardi B and oda stars wey don do secret marriage

Wia dis foto come from, Getty Images
Cardi B done join oda top stars wey no tell dia fans say dem wan marry till dem do marriage finish.
Di American rapper enta Twitter dey yarn say she and her husband Offset do secret marriage nine months ago.
"We see pesin wey fit marry us and she marry us, just two of us and my cousin. I say I do, wit no dress no make up and no ring".
Di rapper say e get tins wey she dey like to share wit di world and e get tins wey she dey keep private, say dia marriage na one of her secret moments.
Cardi B and Offset no be di only celebs wey don do secret wedding wey dem fans no notice. See Odas stars wey don do secret wedding.

Wia dis foto come from, Getty Images
Beyonce and Jay-Z-
Rumour bin dey say di two dey date, but dem fans surprise wen dem file for Marriage license for New York for April 2008. Six months later, Beyonce confirm am say dem don marry.

Wia dis foto come from, Getty Images
Penelope Cruz and Javier Bardem -
Two of dem no even tell anybodi say dem dey date. But dem go do dem private wedding for Bahamas for 2010 as one of dem tok tok pesin confirm.

Wia dis foto come from, Getty Images
Janet Jackson and Rene Elizondo -
Tori about Jackson second marriage begin show wen she divorce her husband and video director Rene Elizondo for 2000. She and Elizondo bin don work togeda for 15 years.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Margot Robbie and Tom Ackerley -
Di couple no announce dem engagement , but dem go do secret marriage for Australia two years ago. Robbie later announce dia marriage wen im post instagram picture wey show dia wedding ring.

Wia dis foto come from, Getty Images
Janeane Garafalo and Rob Cohen -
Dia tori na wa! Di couple dey married for 20 years but two of dem no know. Dem marry for Las Vagas for ova 20 years. But dem no realize say di agreement dey real. Na wen Cohen wan marry im new fiancée, lawyers go dig out di old marriage certificate. Di couple immediately file for divorce.
See wetin Cardi B tweet.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post












