Invasion of Privacy: Cardi B get belle

Wia dis foto come from, Getty Images
US rapper Cardi B don release anoda new surprise; she get belle.
Cardi B wey her real name na Belcalis Almanzar, show di belle for her performance for comedy show - Saturday Night Live as she bin dey perform song from her album, "Invasion of Privacy".
Invasion of Privacy bin drop for 6 April with plenti noise.
Before now, rumours don dey go round say she bin get belle afta she post some videos for social media for di last days before di album drop.
Afta di performance, her friend post video wey she talk say she don finally free.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Her fiancé, US rapper Offset wey dey di group Migos, write im own message for social media after di release.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
She bin don deny rumours say she get belle for di 2018 Grammys, say she just dey fat. She say, "make I fat in peace".
Dis go be her first pikin but na her fiancé fourth. She and Offset bin engage for October 2017.
End of Di one wey oda users dey read well well











