Grammy 2018: Wetin to expect

Wia dis foto come from, Getty Images
Grammy Award don land again and dis time, na New York dem dey do am.
Dis music awards night don talk say dem wan use style take chook mouth for di Time's Up movement wey dey happen.
Dis na as dem don show seating plan to see people wey no dey come.

Wia dis foto come from, Getty Images
Drake dey boycott di awards show because of how dem only put im music for di rap category last year and im say e no know why.
But apart from di people wey no show face...
Wetin you fit expect from di 2018 Grammys

Wia dis foto come from, Getty Images
Miley Cyrus go sing duet with di legendary Elton John
Miley Cyrus don dey post di news for social media to show say she dey happy.
Dis na as Sir John don talk say na di last World Tour im wan do dis year.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Ke$ha go show face for Time's Up movement.
No black cloth uniform for dis Grammy but e no go stop Ke$ha wey go perform today to put eye for di matter.
Dis na as some female stars and executives dey plan to wear white rose for dia cloth.

Wia dis foto come from, Getty Images
History fit happen.
Dis na for di "Song of di Year" category where rap and Spanish pop fit make history as di first time dis type of music go win.
Jay-Z "4:44" be di contender for rap and Luis Fonsi and Daddy Yankee with Justin Bieber "Despacito (rmx)" dey for Spanish pop.
Cardi B also get nomination for two awards - Best rap song and Best rap performance. Dis na award wey single female rapper never win even as dis Grammy na di first she dey go.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wia Beyoncé dey?
Well, dis year, Beyoncé no release any song during di period wey Grammy fit nominate but remember say na di same year she born her twins.
Anyway, since she no be Lagbaja, she fit be co-winner if Jay-Z "Family Feud" carry di award for Best Rap/Song Performance.
Who no go fit show?
We don talk say Drake no go show because e dey vex for di category wey dem put am.
Another person na Justin Timberlake wey dey prepare for im Superbowl performance and Ed Sheeran.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2











