Manchester City beat Arsenal 2-1 as dem throw title race open

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester City beat Arsenal 2-1 for di Etihad stadium to close di gap between dem and Arsenal.
Erling Haaland second half goal make di difference for Pep Guardiola men as dem start to pressure Arsenal from di beginning of di match. Raya Cherki score Manchester City goal for di 16th minute.
Arsenal no see beta space play until di 18th minute wen Kai Havertz score for di Gunners.
Manchester City press Arsenal for di second half sotay dem no get any shot on goal until di 58th minute wen Gianluigi Donnaruma block Eberechi Eze goal bound shot wit im body for di second half.
Arsenal try evritin dem fit do but dem just dey miss chances anyhow.
Action and emotions rise for di second half wen Gabriel bin attack Erling Haaland as e waka go meet am wia im stand kon nod am for di 83rd minute.
Kasala burst as evriwia scata Arsenal and Manchester City players begin attack each oda.
To settle di mata Referee share Yellow card both Gabriel and Haaland. Pep Guardiola wey be Manchester City coach collect yellow card too.
End of Di one wey oda users dey read well well
As e be so, Manchester City get 67 points while Arsenal get 70 points. If Manchester City beat Burnley on Wednesday dem go get equal points wit Arsenal.
E mean say di next five Premier League matches dey veri important to decide who go win di title.
Match highlights
Second Half
Full-Time Manchester City 2-1 Arsenal
90+7 Match don end o!
90+7 Leandro Trossard play beta ball from di right, Kai Havertz jump but im header go inches ova di bar. Mikel Arteta dey for ground in frustration. Im no believe am.
90+4 Arsenal dey attack seriously but Manchester City dey defend well - Bernardo Silva block di run of Leandro Trossard.
90' Referee add 7 minutes
89' SUBSTITUTION Rodri don comot Nico González replace am.
85' SUBSTITUTION for Man City, Rayan Cherki don comot for Phil Foden for while Viktor Gyokeres enta for Martin Zubimendi for Arsenal.
84' YELLOW CARD Manchester City coach, Pep Guardiola don collect Yellow card too.

Wia dis foto come from, Getty Images
83' YELLOW CARD. Kasala don burst for field o, Gabriel of Arsenal go attack Haaland, di referee give two of dem yellow card.
80' Na about 10 minutes of normal time remain and both Arsenal and Manchester City dey press each oda.
77' Corner kick for Manchester City, dem play am but Arsenal defence block am, Arsenal win di ball and dem begin do counter attack for City goal area but Bernado Silva clear di ball to safety.
75' Double change for Arsenal as Leandro Trossard and Ben White replace Eberechi Eze and Christian Mosquera.
73' Odegaard of Arsenal miss chance to equalise.
71' Na less dan 20 minutes remain for dis game to end. Di title race still dey open.
65' Rodri bin hold di ball to draw defenders come out, im attack, one cross, e miss am but di ball run go meet Haaland wey put am inside di net. The stadium vibrate wit di goal..
Manchester City 2-1 Arsenal
65' GOALLLLLLLLL for Manchester City! Haaland score
65' Manchester City player Erling Haaland head di ball but e fall go meet Cristhian Mosquera for fromt of dia own goal.
63' Arsenal don wake up wit Eberechi Eze strike! but e hit di bar!
58' CHANCE for Arsenal but Gianluigi Donnarumma block di goal bound ball wit im body.
56' Arsenal neva attempt any shot for dis match since dem score for di18th minute equaliser.
54' Kai Havertz fall afta tackle from Abdukodir Khusanov, Arsenal fans scream for a free-kick and possibly more, but referee Anthony Taylor say notin hapun, VAR agree too.
53' Anoda big chance for Manchester City as Jeremy Doku run wit di ball but e shoot di ball straight to David Raya.
51'Beta ball wey Rodri play. Im run from di right, e pass di ball from inside im own half but Semenyo first touch too poor and e waste di chance.
51' Arsenal bin dey try enta City goal area but Haaland defend di ball. Goal kick for City.
50' Man City hold di ball, dem dey play short-short passes but Arsenal tiff di ball from dia leg.
48' Manchester City no wan take chances as dem begin rush dis second half
46' Second half don start

Wia dis foto come from, Getty Images
First Half
Manchester City 1-1 Arsenal
45+1 First half don end
45' Referee add only one minute
42' Di blocking and challenge dem no be small tin for di last last few minutes bifor half-time, Piero Hincapié of Arsenal throw imsef for front of Antoine Semenyo of Manchester City shot. Beta defending.
40' Abdukodir Khusanov for di oda end block Noni Madueke as e jump pass Bernardo Silva challenge e give Christian Mosquera di ball for di right side. Di cross be like say e go meet Kai Havertz but Khusanov first am reach and e put di ball for back.
38' Martín Zubimendi block di pass wey suppose go meet Nico O'Reilly, im also stop Jeremy Doku make im no fit reach di loose ball.
35' Arsenal fail to clear di ball from di corner well and Abdukodir Khusanov fire am go back into di box, Marc Guehi jump but di header go straight to City goalkeeper David Raya.
33' Manchester City goalkeeper Raya save beta goal attempt from Arsenal di two sides just dey fire each oda from all angles.
32' Erling Haaland manage to slip di ball through to Bernardo Silva inside di box but Silva shot deflect behind for dat important moment.
31' Manchester City dey play short-short passes but dem lose di ball to Noni Madueke of Arsenal.
28' Noni Madueke of Arsenal get chance but e play an enta goalkeeper hand. Goal kick for Manchester City.
22’ Di tempo of di match still dey hot as Manchester City and Arsenal still dey drag each oda.

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester City 1-1 Arsenal
18’ GOALLLLLLLLL for Arsenal! Gianluigi Donnaruma make mistake, Kai Havertz pursue di ball, e later get di ball and fire am inside di net.
16’ GOALLLLLLLL! for Manchester City!
Rayan Cherki bin dey clear di header from far and di ball fall outside di box im dribble in way pass di defence and shoot di ball into di far corner!
15’ Manchester City defender clear di threat from Arsenal as Mosquera bin wan fire shot near di goal area.
12’ Goal kick for Manchester City wey dey try to break Arsenal defence but di Gunners no dey give dem space.
10’ Corner kick for Arsenal afta ManChester City play foul Odegaard, e play am but City defenders clear di threat.
8’ Arsenal still dey try to settle down for do game but Doku collect di ball from Arsenal leg e run enta Arsenal goal area, e give di ball to Semenyo wey kivk am out of play.
4’ Declan Rice save Arsenal as e save Antoine Semenyo for di right side of di box, e stop di corner kick wey suppose hapun.
4’ Only about four minutes into di match and Manchester City dey worry Arsenal defensive.
3’ Manchester City start dis match wit beta ginger as dem begin wit early tackles, dem no dey allow Arsenal settle down wit di ball.
1’ Match don start
Line up

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester City starting 11: Donnarumma, Nunes, Khusanov, Guéhi, O'Reilly, Rodri, Bernardo, Semenyo, Cherki, Doku, Haaland
Arsenal starting 11: Raya, Mosquera, Saliba, Gabriel, Hincapie, Rice, Zubimendi, Eze, Odegaard, Madueke, Havertz













