You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
2019 election: Buhari don appoint Festus Keyamo as talk-talk pesin for im campaign
Read am in 1 mins
Nigeria president Muhammadu Buhari don appoint Festus Keyamo (SAN) as Director for Strategic Communications for im 2019 presidential campaign.
Na Rotimi Amaechi wey be Transport Minister and Director-General for President Muhammadu Buhari Campaign Organisation give am di job.
Dis appointment mean say Keyamo na di official talk-talk pesin for oga Buhari campaign for 2019.
Keyamo enter Twitter talk dis one. Im say e go soon give im official statement on top di mata.