You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Buhari respond to Nigerians wey demand say make im run for 2019 - Presidency
Presido Muhammadu Buhari say na Nigerians demand make im run again to be presido for 2019.
Im personal assistant for New Media, Bashir Ahmad bin first break di tori for im twitter page on Monday, say di presido go run again.
E no tey wey di official presidency handle also retweet am:
Dem come also release statement wey Senior Special Assistant to di President on Media & Publicity, Garba Shehu sign wia im talk say na Nigerians ask for di president to run again.
"President Buhari make di declaration for closed-door meeting of di National Executive Committee of di All Progressives Congress (APC).
"Di presido say im dey respond to demand by Nigerians to re-contest for 2019, come add say im wan first tell di NEC of im party to honour dem," oga Shehu talk.