Buhari re-election go give us Biafra - Ipob

Read am in 2 mins

Nigerians still dey react on top news say presido Muhammadu Buhari go run for next year presidential election.

From PDP to Afenifere, Ipob and pipo for social media, Buhari re-election talk na im full dia mouth.

Di opposition People's Democratic Party (PDP) talk-talk person, Kola Ologbodiyan say e sure say Nigerians no go vote pesin wey go kill dem enta office again, as plenti pipo don die for di three years wey e don be presido.

Yoruba group Afenifere say na Buhari right if im wan run for election again but na for Nigerians to decide weda dem wan chose am or comot am. Dia talk-talk pesin Yinka Odumakin na im tell BBC Yoruba dis one.

Even di Indigenous People of Biafra (Ipob) oga of media for Abuja, Peace Chukwudi talk say, "na beta tin for Buhari to run again because if im win, e go fit ginger we fight for di Biafra pipo to get we kontri".

For Twitter, Oby Ezekwesili of di Bring Back Our Girls group, say wen she hear di tori, e remind am about masquerade.

Dis pesin wan sell Nigeria instead of Buhari to enta back as presido.

Dis pesin dey remind Buhari say for 2011, e bin talk say na only one term e go spend for office.

Dis pesin dey tell pipo say no be wetin dem write for social media dem go count for election day.