Mo'Hits: D'banj and Don Jazzy don announce reunion

Wia dis foto come from, Getty Images
BBC News Pidgin bin predict some music collabo wey fit happen dis year and now e happen.
E be like say Christmas come early for some Nigerians wey dey follow entertainment mata.
D'banj don announce say Mo'Hits don redi to come back together six years after dem breakup di group.
Former oga of di Mo'Hits record Don Jazzy follow announce with style for im social media to prove say dem no dey bobo Nigerians.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
To start dia new music waka, di group do music tour wey dem dey call "The Mo'Hits Reunion Tour".
Dem neva talk di date wen dis tour go happen but D'banj say make pipo watch out for am.
Mo'Hits wey be one of di biggest music group for di early 2000s for Nigeria bin scatter afta internal wahala start between Don Jazzy and D'banj.
Some of dia big music hits be 'Why Me,' 'Gbono feli Feli,' 'Pere,' 'Oliver Twist'
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Mo'Hits crew get Don Jazzy, D'banj, D'Prince, Dr Sid, K-Switch and Wande Coal as di members.











