Winter Olympics 2018: Buhari troway twale give Team Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria President Muhammadu Buhari don troway salute give athletes wey dey represent Nigeria for di 2018 Winter Olympics for Pyeongchang, South Korea.
Di president say di team do well as dem make history to be di first Nigerians wey go participate for di competition.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di women's bobsleigh team get Seun Adigun, Ngozi Onwumere and Akuoma Omeoga and Olympian Simidele Adeagbo go represent Nigeria for Skeleton for di Games.

Wia dis foto come from, Getty Images
Mr Buhari say di country stand gidigba behind dem throughout di competition as dem choose to use patriotism, sacrifice, hard work and personal dedication to carry di Nigeria flag for di PyeongChang Olympic Stadium in South Korea.







