Akwasi Frimpong
- Age: 31
- Country: Ghana
- Sport: Skeleton
Akwasi Frimpong na him start Ghana national Bobsled and Skeleton Federation (BSF-Ghana) for 2016.
Frimpong na sprinter before but achilles injury force am to change to another sport.
E dey take about four to six years for person to dey fit compete well-well and learn di sport because e dey go very fast wey be say even your brain fit no handle am.
Sabrina Simader
- Age: 19
- Country: Kenya
- Sport: Alpine Skiing
Simader, wey her family bin move go Austria wen she bin dey three years old, na di first alpine skier to represent Kenya for di Winter Olympics.
She begin dey ski for competition for 2013. for 2016 she bin represent di East African nation for di Winter Youth Olympics for Norway.
Kenya people dey very impressed. Dem don give me plenty support and na dat one dey give me power.
Mialitiana Clerc
- Age: 16
- Country: Madagascar
- Sport: Alpine Skiing
Mialitiana Clerc bin learn to ski wen she be just three years old for France. She become 16 years old on November 16, 2017 dis one don make her one of di youngest athletes for di games.
Samir Azzimani
- Age: 40
- Country: Morocco
- Sport: Cross-Country Skiing
Samir Azzimani bin dey compete for alpine skiing before im come change to cross-country skiing.
Adam Lamhamedi
- Age: 22
- Country: Morocco
- Sport: Alpine Skiing
Moroccan-Canadian Adam Lamhamedi bin make history wen him become di first African wey win gold for di Winter Youth Olympic Games for Austria for 2012.
Moriam Seun Adigun
- Age: 31
- Country: Nigeria
- Sport: Bobsleigh
Seun Adigun na she start Nigeria first ever Bobsleigh team. Na she be di driver for di team.
She be former track and field athlete wey bin compete for 100m hurdles during di 2012 Summer Olympics for London.
E still be like say no be true for me . . Nigeria never get anybody wey represent dem for di Winter Olympics before and dem dey jolly asy e go finally happen
Akuoma Omeoga
- Age: 25
- Country: Nigeria
- Sport: Bobsleigh
Akuoma na di “brakewoman” for Nigeria first ever bobsleigh team.
She still dey work for healthcare recruitment.
Ngozi Onwumere
- Age: 26
- Country: Nigeria
- Sport: Bobsleigh
Ngozi Onwumere na track and field athlete before wey and she bin represent Nigeria for di 2015 All African games.
Simidele Adeagbo
- Age: 36
- Country: Nigeria
- Sport: Skeleton
After nine years holiday wey she no compete for any sport, Simidele Adeagbo bin dey inspired by di Nigeria Bobsleigh team and she come decide to become skeleton athlete.
Adeagbo na di first Nigerian wey go compete for dis sport for di Winter Olympics.
Connor Wilson
- Age: 21
- Country: South Africa
- Sport: Alpine skiing
Connor Wilson bin go school to become vet for University of Vermont for US.
Mathilde-Amivi Petitjean
- Age: 23
- Country: Togo
- Sport: Cross-Country Skiing
Mathilde-Amivi Petitjean na member of France junior cross-country ski team before, now she don change to represent Togo, di country where dem born her.
Alessia Afi Dipol
- Age: 22
- Country: Togo
- Sport: Alpine Skiing
Upon say e no get any family member for Togo, Alessia Afi Dipol wey dem born and she grow for Italy don choose to represent di West African country.
First time wey dis Alpine skier go compete under di flag of Togo na for di 2014 Winter Olympics for Sochi.
Shannon-Ogbani Abeda
- Age: 21
- Country: Eritrea
- Sport: Alpine skiing
Abeda grow up for Canada and him bin wan become ice hockey player, but him parents come think say skiing na di sport wey go better for am pass.
Na him be di first Eritrean wey go represent di country for di Winter Olympics.
I know say e no common for Eritrean person like me to become skier, but Eritean people na very patriotic people. Anytime wey dem see person wey dey compete or represent Eritrea for beta thing, dem dey happy well-well
Person wey snap di picture:
Matthias Hangst/Getty Images, Dimitar Dilkoff/AFP/Getty Images, Francois Xavier Marit/AFP/Getty Images, Shaun Botterill/Getty Images, Christophe Pallot/Agence Zoom/Getty Images, Alexander Hassenstein/Getty Images, ALEXANDER KLEIN/AFP/Getty Images, Dean Mouhtaropoulos/Getty Images, Courtney Hoffos