Nigerian rapper Olamide mama don die

Olamide.

Wia dis foto come from, Getty Images

Popular Nigerian rapper Olamide don lose im mama to death. Di rapper bin enter im Instagram page on Tuesday evening to announce di information to im fans.

Olamide write for im Instagram page for Yoruba langauge, "Orisa bi iya o si," wey mean "no god dey like mama", come put heartbreak emoji join.

Di star performer wey im real name na Olamide Adedeji wey bin lose im papa some years back, no write wetin kill im mama, or when she die.

Olamide Instagram post.

Wia dis foto come from, Baddosneh/instagram

Na just dis month Olamide drop tear-rubber single wey im call "Science Student" and e don face plenty wahala for social media because of di song.

Plenty of di rapper fans don begin tell am sorry, say make im take heart.