Fulani Herdsmen: Southern governors don reject cattle colony

Wia dis foto come from, Getty Images
Southern states for Nigeria don shun federal government request to do cow colony for inside dia states.
As di plenty clash dem wey don dey happen between herdsmen and farms for many years now don worse, Nigeria federal government believe say na cow colony go fit settle di matter.

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis idea to give dia land to herdsmen, according to Nigeria newspaper Punch, no settle well for di belle of southern governors.
Last week Minister for Agriculture and Rural Development announce say, from dis week, dem go begin to do colony for di states wey gree give land for di colony.

Wia dis foto come from, Getty Images
But dis January, plenty governors wey dey control states for di south say dis federal government plan na mago-mago.
Ebonyi governor, David Umahi, say dem wan use style collect land from dia people. Okezie Ikpeazu for Abia talk say land never reach dem to do farming sef, talk less of make dem come give am to cattle.
Ekiti state governor, Ayo Fayose, be one governor wey im voice loud well-well on top dis mata as im talk say e no make sense say government go chook mouth for cattle business wey no concern dem.

Wia dis foto come from, Getty Images
So far na 16 states don agree to give land and all of dem na from di north of Nigeria.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di states include Adamawa, Kano, Kaduna, Katsina, Zamfara, Kebbi, Nasarawa, Plateau, plus including Bauchi, Gombe, Borno, Jigawa, Yobe, Niger, Kogi and Kwara state.
Di ministry talk say dem no go force any state wey no wan give land sha.











