Buhari: Herdsmen attack go soon stop

Wia dis foto come from, AFP/Getty
President Muhammadu Buhari on Monday promise Nigerians say all di kill-kill by herdsmen for di country go soon dey under control.
Buhari say di security people wey dem post go di areas wey di herdsmen wahala dey happen, go help dem solve di problem.
Femi Adeshina wey be di President Special Adviser for Media and Publicity talk say di herdsmen attack don bring sorrow and hardship for Nigerians and e don also affect government well-well.
President Buhari say im administration dey put eye well-well inside security, corruption and unemployment mata.






