2017 CAF Awards: People bore chakaa for Ghana

Mohammed Salah (left) dey collect award from CAF President Ahmad Ahmad (right)

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI/AFP/Getty Images

Wetin we call dis foto, Na Mohammed Salah (left) win di African Football of di Year wey CAF President Ahmad Ahmad (right) give am
Read am in 2 mins

Di best way one fit take describe di 2017 Confederation of African Football (CAF) Awards wey happen dey like you dey chop koko sakora, no sugar, bread or koose, e just no dey happen!

Sports lovers, journalists den fans for social media bore chakaa sake of di 'nyama-nyama' tins wey happen for di event under inside Accra, Ghana last night.

Wetin we call dis Video, How di 2017 CAF Awards take happen

You figure say e be play, check dis people bore.

Skip Facebook post, 1

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 1

Reports be say den sound quality be poor, di wey di organisation flop to di extent say at one point saf CAF President wait teee! for George Weah in platinum award.

Skip Facebook post, 2

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 2

CAF for make steady with dem shambolic events

Football journalists den fans start dey raise questions about how CAF go fit push make we host World Cup for Africa with dis kind yawa event organisation. Gary Al-Smith be Sports Journalist for Ghana.

Wetin we call dis Video, "Dem things be shambolic"

Ghanaians no like di music performance

One matter too be say some Ghanaians no happy sake of dem populate di music performances with more foreign artistes, although two artistes for Ghana open den close di awards.

Skip Facebook post, 3

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 3

Skip Facebook post, 4

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 4

Despite di shambolic nature of di awards night, den e be all joy for Egypt and Liverpool player Mohammed Salah who carry di crown as 2017 African Player of the Year.

E beat im Liverpool team mate Sadio Mane of Senegal and Pierre-Emerick Aubameyang wey dey play for Borussia Dortmund and Gabon.