Salah don do award hat-trick after im win CAF African Footballer of di Year

Mohammed Salah

Wia dis foto come from, JULIAN FINNEY/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Mohammed Salah dey number 2 for di highest goals for premier league dis season
Read am in 1 mins

BBC African Footballer of di Year, Arab Footballer of di Year and CAF African Footballer of di Year. All na one person - Mohammed Salah.

Di Egypt and Liverpool player don chop hat-trick after im carry di crown as 2017 African Player of the Year.

Na di Confederation of African Football (CAF) give am di award for Ghana in capital, Accra.

E beat im Liverpool teammate Sadio Mane of Senegal and Pierre-Emerick Aubameyang wey dey play for Borussia Dortmund and Gabon.

Mohammed Salah talk sey to win di award mean say im dream don come true and 2017 na correct year for am.

"I go like dedicate am to all di pickin dem for Africa and Egypt. I wan tell dem say make dem no stop to dey dream, make dem never stop to dey believe.

"I would like to dedicate it to all the kids in Africa and Egypt, I want to tell them to never stop dreaming, never stop believing."

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Meanwhile, Salah be di second Egyptian wey win di CAF African Footballer of the Year Award.

Na Asisat Oshoala of Nigeria win di Africa woman player of the year.

Mohammed Salah come join di ranks of top ballers for Africa wey shine well-well for club and country.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2