Ghana: UN Rep talk why dem vote against Israel

Wia dis foto come from, @pobee_martha
Ghana say di reason why dem vote against US decision to move im embassy go Jerusalem na to join bodi with United Nations (UN) and Africa Union (AU) resolution.
Na Ghana UN representative Martha Ama Pobee, talk dis one, after some Christian people for di country vex say dem no happy with di country decision on top di matter.
Di country dey among di 128 countries wey vote against president Donald Trump decision for United Nations.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Ms Pobee say US decision no pure, because e go scatter plan for Israel and Palestine to get dia own different countries.
Tori be say anoda reason wey make di decision dey one kain na because UN and AU don first agree say na serious negotiation between Israel and Palestine go fit settle Jerusalem matter once and for all.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Even though say many Ghana people enter social media dey vex say dia country wey call im self Christian country suppose encourage Israel to take over Jerusalem.
Di official stand of some Christian world leaders like Catholic Pope Francis be say make everybody try maintain di decision of United Nations on top di matter.






