Ghana: Christians dey blast Jerusalem vote

Wia dis foto come from, Dan Kitwood/Getty Images
Check like some Ghanaians no dey happy sey Ghana dey side plus UN resolution against US President Donald Trump ein decision sey ei make we recognise Jerusalem as Israel ein capital.
Some church people for social media dey talk sey dem make disappointed over government ein decision, some self describe am sey ei be 'shameful' as we dey claim sey Ghana be Christian nation (you for know sey dis religious position no dey wanna official records inside).
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
For interview plus BBC Pidgin, Professor Emmanuel Martey, wey be Presbyterian Church of Ghana demma former moderator talk sey government make mistake wey "dem for minimize demma mistakes...dis Ghanaian leaders dem know Israel ein history well well? Why dem want deny some people of demma capital?"

Wia dis foto come from, KAMBOU SIA/AFP/Getty Images
Professor Martey dey feel say dem "cheat" Israel. Despite sey President Trump no fit display common sense sometimes, for dis matter dier ei make faithful say ei want recognise Jerusalem Israel ein capital so sey dem put American Embassy for der.
Di Christian Council of Ghana ein General Secretary Rev. Dr. Opuni-Frimpong talk we say ei no fit comment on di matter.
More people for Ghana be Christians, but chaw Muslims too dey across di country.







