Premier League fixtures: Liverpool go play Leeds for di opening game of di season

Wia dis foto come from, Getty Images
Premier League Champions Liverpool (wey be di current tittle holders) go face Championship winners Leeds United (wey just get promotion to English Premier League) for di opening weekend game of di 2020-21 Premier League season.
Championship (wey be lower division of English Football) play-off winners Fulham go jam Arsenal, while West Bromwich Albion, di third promoted side, go play Leicester City for dia house.
Di opening round of fixtures go take place for di weekend of 12 September. But, Manchester City v Aston Villa and Burnley v Manchester United dem go rearrange am.
Those two games dem no go play am for di opening weekend to give City and United 30 days since dia defeats for di quarter-finals of di Champions League and di semi-finals of di Europa League respectively.
See di opening day fixtures for Premier League
Chelsea and Wolverhampton Wanderers opening matches too dem schedule am for Monday, 14 September sake of say dem comot for Europe earlier.
Di Blues go play Brighton, while Wolves go play against Sheffield United.
Di other opening weekend fixtures na Crystal Palace v Southampton, Tottenham Hotspur v Everton and West Ham United v Newcastle United.
Dem go confam di exact dates and kick-off times when dem do di television selections. Dem go play di Matches dem without di fans inside di stadium sake of coronavirus.
End of Di one wey oda users dey read well well
Selected derby matches dem...
- 17 October - Everton v Liverpool
- 5 December - Tottenham Hotspur v Arsenal
- 12 December - Manchester United v Manchester City
- 16 January - Wolves v West Brom
- 20 February - Liverpool v Everton
- 6 March - Manchester City v Manchester United
- 13 March - Arsenal v Tottenham Hotspur
- 1 May - West Brom v Wolves
All dates dey subject to change.













