Mikel Obi: Stoke City don sign di former Chelsea Nigerian midfielder - See oda clubs e don play for

Wia dis foto come from, Twitter/@stokecity
Stoke City don sign former Chelsea midfielder John Mikel Obi.
Stoke boss Michael O'Neill said: "I dey really impressed with am wen we meet for di first time and e outline wetin e want from di next phase of im career.
"We spend four hours dey tok and e make am clear say e wan get back into di Premier League and finish im career dia and hopefully e fit do am for Stoke City."
Which oda clubs Mikel don play inside?
Di former Nigeria captain, 33, become free agent afta e comot di Turkish side Trabzonspor by mutual consent for March.
Mikel make 249 Premier League appearances for Chelsea inside di 11-year spell, wey end wen e comot Stamford Bridge for 2017.
E win di Champions League and Europa League, two Premier Leagues, three FA Cups and di League Cup during e time with di London club.
Afta e leave Chelsea, e join di Chinese side Tianjin TEDA and do small time for Middlesbrough for 2019.
Mikel win 89 caps for Nigeria, e play inside two World Cups and help di Super Eagles win di 2013 Africa Cup of Nations, before e announce e retirement from international football last summer.
End of Di one wey oda users dey read well well
Championship side Stoke win three of dia last four games inside 2019-20 to pull away from relegation trouble and finish 15th under former Northern Ireland boss O'Neill.












