Mikel Obi don retire from international football

Wia dis foto come from, Getty Images
Super Eagles captain Mikel John Obi don announce im retirement from Nigeria national team.
For post ontop social media, Mikel John Obi say thank you to Nigerian supporters and im kontri for di love wey dem don show am for di past 15 years.
"Egypt na di kontri wia I bin start and don finish my National career for," tok Obi as im use di Instagram post as opportunity to give history lesson on im career.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
At age 32, Obi say im don ready to retire to let di young footballers take over.
For di Afcon 2019 wey di Nigerian team carri third place inside, Obi play just two matches out of all di seven matches wey di team play.










