South Africa vs Nigeria: Three tins to expect wen Super Falcons jam Bayana Bayana for Cape Coast

Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria go play South Africa for dia opening match for Group B
Read am in 2 mins

Nigeria senior women football team, Super Falcons and South Africa women team, Bayana Bayana dey eye three precious points wen dem jam on Sunday.

Di two teams go play dia opening group match for di 2018 Africa Women Cup of Nations inside Robert Mensah Stadium, Cape Coast, Ghana.

Super Falcons na di defending champions and many pipo dey tip dem to win am again for Ghana but as dem no dey change goal post for middle of match, see three tins to expect for di match.

Nigeria New Coach

Thomas Dennerby

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Thomas Dennerby na former coach of Sweden

Dis na di first time Nigeria coach Thomas Dennerby go carry di Super Falcons go any major competition.

Di former Sweden women coach wey manage di Europeans from 2005-2012 carry dem reach third position for 2011 Women's World Cup for Germany, di 59 -year-old get plenty experience well-well wey make Nigeria Football Federation (NFF) employ early dis year.

Dennerby go hope say im team go carry on with di form wey don see dem win eight of the previous editions starting with victory against South Africa.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

South Africa starting formula

Bayana Bayana

Wia dis foto come from, @Banyana_Banyana Twitter

Wetin we call dis foto, South Africa don win Nigeria once for dia last eight meeting

Bayana Bayana sabi start slow for competition but dia captain Janine van Wyk say na something dey need to correct dis time around for Ghana.

Dis two kontries don meet eight times for international level and na Nigeria get upper hand, di only time dem beat Nigeria na for 2012 and na van Wyk score di goal.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

'Superzee'

Asisat Oshala

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Asisat Oshala dey play her club football for Dalian Quanjian

Superzee na Asisat Oshoala guy name, di three -time African Women Player of di Year na one key players for Nigeria.

For 2016, AWCON she finish di competition as top scorer with six goals, she score two out Nigeria six goals against Gambia for Lagos wey seal Falcons qualification for Ghana 2018.

Oshoala dey fine form, for Chinese Women's Super League she bang im 10 goals in 14 matches to help her club Dalian Quanjian to win dia third straight title.

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 4

Di Group B match go start 3:30pm Nigerian time on Sunday. Only di top three teams for Ghana go fly Africa flag for France for di Women World Cup.