South Africa vs Nigeria: Super Eagles draw wit Bafana Bafana to qualify for AFCON 2019

AFCON 2019

Wia dis foto come from, CAF

Read am in 2 mins

Nigeria Super Eagles draw 1-1 against South Africa Bafana Bafana on Saturday for FNB Stadium, Johannesburg.

Dis result mean say Nigeria don qualify for next year African Cup of Nations (AFCON) competition wey go happun for Cameroon.

Ejike Kanife, wey sabi football wella, tell BBC News Pidgin say e sweet am for belle di way Super Eagles play very tactical football.

Skip Facebook post, 1

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 1

Buhari don hail di Super Eagles

President Muhammadu Buhari on Saturday sama congratulobia give Super Eagles of Nigeria as dem qualify for 2019 Africa Cup of Nations inside Johannesburg.

Buhari belle dey sweet on to say di team use high spirit and discipline perform against dia tough opponent wey come earn dem qualification as dia final match against Seychelles go just be mere formality.

Dis na di first time since 2013 wey di Super Eagles go qualify for di African Cup of Nations.

Simon Kalu open early scoring for di Eagles afta only 10 minutes but Percy Tau equalize for di host, Bafana Bafana.

Di two teams play diasef well well and dem get create plenti chance to increase di scores.

Tau, di main attacking wahala for Nigeria do and do to win more chances for di host but di window no open.

Nigeria Super Eagles

Wia dis foto come from, AFP

Acting captain Ahmed Musa and im boys carri for mind to wire Bafana Bafana and import three points return back to Nigeria even though draw dey enough to qualify.

Na revenge dey di back of di mind of di Eagles afta dem suffer 2-0 defeat for di hand of Bafana Bafana for dia opening AFCON qualifier for Uyo last year.

Di Super Eagles no qualify for AFCON 2017 for Gabon, wey be anoda ginger to qualify dis year and return back to di most important football competition for Africa.

Bafana Bafana

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Percy Tau shine for Bafana Bafana

Super Eagles Gerard Rohr go big up imsef on top im team selection for today and di AFCON qualifier campaign.

Meanwhile For di oda Group E match Libya kamasa Seychelles 8-1.

Ejike Kanife tok say Libya or South Africa still get to qualify sake of say Libya get 7 points while South Africa get 9 and dem get one get remain.