FIBA Women World Cup: Nigeria lose 71-40 to USA for quarterfinals

Wia dis foto come from, JAVIER SORIANO
Nigeria women basketball team D'Tigress don comot for di FIBA Women basketball World Cup afta dem lose 71-40 to USA.
D'Tigress reach di quarter-finals after dem beat Turkey and Argentina for Group B and win Greece for playoff.
Dis na di first time wey di D'Tigress dey reach quarterfinals for basketball World Cup.






