Amaju Pinnick don win election to continue as oga of Nigeria football

Pinnick

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Pinnick na also big man for Caf and Fifa
Read am in 1 mins

Current presido of di Nigeria Football Federation Amaju Pinnick don win im re-election to continue as oga patapata.

For election wey happun on Thursday for Katsina State, Pinnick nack three odas wey follow am contest to win di position.

Di result wey di NFF Electoral Committee release show say Amaju Pinnick get 34 votes, Aminu Maigari - 8 votes, Taiwo Ogunjobi - 2 votes and Chinedu Okoye - No vote.

Dis result mean say Pinnick go do four more years as di presido of di football federation until 2022.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post